Ron Jeremy news: Adult star dey face accuse on top more rape and sexual assault charges

Publish date: 2024-08-09

1 September 2020

Prosecutors for Los Angeles say dem don charge Adult film star Ron Jeremy im use force rape 13 more women, wey include one 15-year old.

Dem say di alleged sexual violence happun for 2004. Dem don already charge di 67-year-old on top accuse say im rape and assault four women between 2014 and 2019.

Ron Jeremy na one of di biggest names in pornography and don feature for inside more dan 1,700 films in 40 years.

If dem find am guilty, he dey look 250 years inside jail. But im deny di accuse.

Oga Jeremy, wey im real name na Ronald Jeremy Hyatt, appear in court for June on top accuse say im rape one 25 year old and another 30 year old women and he sexually abuse two other women wey be 33 and 46 years old.

Di lawyer bin initially deny di accuse say na women dey always rush im client.

But prosecutors receive more allegations of sexual violence days afta he show for court, di Los Angeles Times report.

Di new charges include a total of 20 counts of rape and sexual assault against di 13 women. Di age of di alleged victims na between 15 and 54.

Di most recent accuse na di assault wey dem claim happun for outside one business for Hollywood on New Year's Day dis year.

For 2017, Rolling Stone magazine report say more dan 12 women don accuse oga Jeremy of sexual misbehaviour, wey include to take dey look dem wit lust, dey touch dem for places wey no dey right, non-consensual digital penetration, and sexual assault.

He tell di magazine say im "never and go never rape anyone".

Oga Jeremy dey listed for di Guinness Book of World Records for "Most Appearances in Adult Films" and dem use am as di main subject for inside one 2001 documentary Porn Star: Di Legend of Ron Jeremy.

He has also made numerous cameo appearances in computer games, Hollywood films and music videos for Moby, Guns N' Roses, Armin Van Buuren among others, as well as LMFAO's Sexy and I Know It.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmraeinnp2f5hxaHJsaA%3D%3D